Styl-Plus

Styl-Plus - Iya basira lyrics

rate me

This na one buka wey I dey like to go. The food sweet sote e go make your mind blow, day and night iya bas how she do am I no know. They think say na jazz, my broad no be so.

Chorus: people people make una come o

Iya basira e don jazz me o,ooo

Everybody helep save me o

I no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place

people People make una come o

Iya basira e go kill me o,ooo

Everybody helep save me o

I no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food.

Long throat na food go kill u-no be so, I say na food go kill u – oga mi no be so.

Wettin dey be say e get one day wey I say I go play go see my paddy Sunday,na so I reach there but Sunday e don high on beer luckily for me him junior broad eye e clear, he say make we stroll to the area, little did I knw that I was strolling to my burial. Right there were oshodi bus dey load was a little buka close to the mainroad.

I laf when e pass the door, e tell me say hin name na Iya bas for short but I bow when e order, iwesiatewa , ero mm purewater not even mineral. I come gree say I go manage to chop am before I realize I dey order 2nd round , 3rd round, 4th round, I never still stop

Wetting iya basira e give me chop?

Repeat chorus.

Long throat, na food go kill u, na food go kill u.

Oga mi, u think say na play when I say na the way wey I dey, e no day ok

Wetting be your own advice, I don dey steal my paddy money to buy iya basira rice.

Even on my girlfriend birthday when she dey wait make I take am to ocean view, I no know when I pass the place, the only thing wey dey my mind na Iya basira palm oil stew

Ah! Kilon kilon shele shele me I never see this kind juju, telle telle

All those wey go vex kpele kpele, but I hear say Iya basira na…….

I sure say still I go go there go sidon, order my first round move to 2nd round, 3rd round 4th round I no dey ever stop wetting iya basira come give me chop?

Repeat chorus.

Officer abeggi follow me to the palce, everybody don telli me I dey craze

My girlfriend don leave me my moda no gree see me my paddy ah! Iya basira e don kill me.(2times)

Oya people, people make una stop officer e don come

Where the woman, hin dey inside, (oga I dey come)

Woman na wetting u dey give people chop wey dey cause all this wahala casala, oya make we talk

Oga sir true to God, nothing wey I dey put for the food wey I dey cook, na God dey make am good.

Na which kind talk be that, say na God dey cook the food abi u think say I be fool no be juju u dey put, infact I dey suspect say na….u wash put sote people dey queue come dey rush for your stew, well to confirm am bring am make I chop small. Give me fufu 90 naira plus that soup wey dey draw. Chaii correct this food sweet no be small shey una no go vex if I still order for more.

Officer no worry na the food be this

Oya people, people make una go, case dismiss.

Repeat chorus 2times.

Get this song at:  amazon.com  sheetmusicplus.com

Share your thoughts

0 Comments found