Lagbaja

Lagbaja - Naija must sweet again lyrics

rate me

Nigeria na one country, yes

The thing God done put together, let no man put asunder

But sha if we no go scatter am we must balance am well well

Everybody must happy

Some no go dey belle full make others dey hungry, Haba

One day hungry man go angry o

Leadership, government, president no be personal property

Power no be birthright

Equal rights and justice na him go bring unity and progress

Solution to make Nigeria better, E dey here for Naija

If we find better leader Nigeria go better o

Correct brain with correct solution he boku for Naija

Haba, sebi na chop chop na him close sense

Oyinbo wey him organise, se him get two head

Hisshh, Naija it done swet before before o,

It must sweet again gan

Country hard, country hard (horns)

Na him I pack my load, I check out

Baa ba nrelu oyinbo ka mohun a nwa lo (horns)

En I dey o I dey go I dey go ilu oyinbo

Se iyawo wey he never taste two husband house

He no go know which one sweet pass (horns)

Because of pounds and dollars I face yankee

My visa expire still mo nfa gburu (horns)

Otutu pa sege olopa o de gbodo gan mi

Emi omo onile olona mo wa di gbaatu eyo (horns)

If I greet oyinbo for road he go point him nose for sky

Emi omo afojapon omo onile olona, big man for my area

Wolukilumo, Eni ko o mo eni mo o ko

Iya mi o gbodo gboya to nje mi aya nbe nile omo nsuffer

Haa, kese, mo ranti ile mo forin aro bonu

Oh my home oh my home, When shall I see my home

When shall I see my native land, I will never forget my home

After my eye clear I pack my luggage ile ya

Ko baje funlu oyinbo enough is enough

Before I get visa nko I know how I suffer

Mo tun wa debi tan perambulation (horns)

O yes I made some bread man, but home na home now (slam horns)

If them tell you say yonder dey sweet gan, is a lie

Many of my people yonder na suffer head (horns)

Oyinbo self nko, illiterate boku, some cannot read, some cannot write

Ignoramus asoyinbo naa le tabon (horns)

Me wey I think every oyinbo get money haaa

Ase many of them na poverty (horns)

E ma si mi ye oo mi o so pe ilu oyinbo o dara (slam horns)

Of course o dara lopo, organisation correct ni

But as we get our problem them get them own (horns)

So why can’t we too sit up and do something, wake up let’s make life easy

Yeah yeah Naija o ni gba e

Oke ga joke Olagbaja ga ju won lo

Oke ga joke Naija ga ju won lo

Oke ga joke Africa ga juwon lo

…………………Naija must sweet gan

Before before Naija sweet gan o

But now Naija bitter gan

We must find a solution kia kia

Naija he done sweet before it must sweet again o

It just be like yesterday when everything change o

Little by little everything yamutu

Titi titi everything come dabaru like tailor leg o

As it be for Naija na so for Africa

Oh I sorry for Africa

How the future he go be for our children

If you suffer and your children them no suffer

At least you go know the thing wey you suffer for

But as I dey look am so

Them own suffer head na him go terrible

This one na multigenerational disaster

Except we wake up and we do something now

The problem wey he dey for ground it done pass for example

Se na foreign exchange we go talk ni abi na corruption make I talk ni

Oh I sorry for Africa

Ehhh everything just dey bitter now

Ehh everything just bitter o

Naija must sweet gan and me I no go thief

For my very very before it must sweet dan dan

Naija…… Naija……..Naija na my country it must sweet ni

I no go run anywhere home na home now

Naija must sweet gan, it must sweet ni

Naija………Naija

Get this song at:  amazon.com  sheetmusicplus.com

Share your thoughts

0 Comments found