Lagbaja

Lagbaja - Me And You No' Be Enemy lyrics

rate me

We come from different places / Speak with different tongues / But all tongue is red / For we are the same / We are brothers and sisters / We may be different cultures and nationalities / But all tongue is red / For we are the same / For we are the same / My brother, my sister

When Igbo meet Yoruba / Him no go know / Who come from where o / For him eye o / Chorus: All of them na the same / Whether na from Ofa, Ijebu, ab'Egba / All of them na the same / Modaeke, Ife, Ogbomoso, ab'Osogbo / All of them na the same / Ilesa, Ab'Oyo Ile / All of them na the same / Everybody na family o /

Ghana wey come Naija nko / Him no dey know (lai lai) / Who come from where o / For him eye o / All of us na the same / I say for him eye se / All of us na the same / Whether na Efik, Tiv, Ibibio, or Urhobo / All of us na the same / Whether na Nupe, Hausa, Ijaw or Itsekiri o / All of us na the same / Everybody na family / Think well well you go see

Chorus: Me and you no' be enemy / We suppose to be family / Na what you dey find, I dey find

Abi na what you dey find my brother / Sebi na what you go chop you dey find / Na what I go chop I dey find / Na the same thing we dey find o / Struggle for survival / To come out from poverty / Na the same thing we dey find o / You see brother, sister

Chorus: Me and you no' be enemy / We suppose to be family / Na what you dey find, I dey find

Eh...eh...eh...eh... / We be family / Created by the same Creator / Sebi we dey live together before o / We dey share together before o / We dey suffer together before o / Sebi we dey marry together before o / Ki lo wa de? / Me and you no' be enemy / we suppose to be family / Na what you dey find / I dey find

All tongue is red / For we are the same / My brother, my sister

When you self see oyinbo / How you go know / Who come from where o / For we eye o / All of them na the same / Oyinbo wey meet Africa man / Him no dey know / Who come from where o / For them eye o / All of us na the same / Whether na Wolof, Madingo, or Zulu / All of us na the same / Ashanti, Fulani or Edo / All of us na family

Chorus: Me and you no' be enemy / We suppose to be family / Na what you dey find / I dey find

Na what you go chop you dey find / Na what I go chop I dey find / Na the same thing we dey find o / Ayeele o / Which kind madness be this / Bo ba pa mi / Won a pa e / If I die you go murd / Because my people go revenge / And then your people go avenge / And then my people retaliate / Avenge... revenge...

revenge.... avenge... venge... venge..., venge... retaliate / Na so the madness go dey go back and forth from generation to generation o / Which kind madness be this o / Everywhere na fear / Everyday you go dey look for your back / You dey fear / Who dey come / Who dey go / Wey pickin, wey mama / Brother nko, sister nko / Ha! ab'on tun ti... ? / Aaah! Ki lo de? /

Chorus: We be family o

Why brother go dey kill him brother / When all of us na the same family o / Pabambari, pabambari awon kan tun lo jo 'le Oluwa / Aaa! / No matter your religion / No matter where you come from / No matter nationality o / All of us are created by God / All of us na the same / Na the same thing we dey find / Do your own, make I do my own / Everybody same family o / We be family / We be family / We be family O...

Get this song at:  amazon.com  sheetmusicplus.com

Share your thoughts

0 Comments found